Afrobeat

Page: 8

Bella Shmurda Talk Say If E No Be Musician, E For Don Be Preacher Nigerian Afrobeats singer Bella Shmurda don talk say if e no be musician, e for don be preacher or motivational speaker. The guy wey sing ‘Triumphant’ yan say e sure say preaching na him true purpose. Shmurda yan this one for […]

E No Make Sense When Artiste Just Dey Sign Another Artiste Just to Show Say E Don arrive – Simi Nigerian singer, Simisola Kosoko, wey people sabi as Simi, don talk her mind about di new style wey big artistes dey open record label to sign upcomers. She yarn say she fit mentor up-and-coming musicians, […]

Peter Okoye Don Vex, Call Out Him Brothers Paul and Jude Say Dem Wan Spoil Him Name Peter Okoye, one half of the former P-Square duo, don carry him vex go social media to para for him brothers, Paul and Jude. He accuse dem say dem wan spoil him name on purpose, especially as dem […]

E Easy to Blow Now Pass How E Be for 2000s – Timaya One of di OG musicians for Naija, Timaya, don yarn say to enter music industry now dey way easier pass how e be for 2000s to early 2010s, when him and him padi dem dey run things. As e dey talk for one […]

Spotify do Masterclass for artists on how to fight stream farming wahala Di global streaming platform, Spotify, don dey double their effort to fight the gbege wey fake streaming dey cause for music industry. Fake streaming wey involve things like bots wey just dey run music on repeat or click farms still be serious problem […]

Daniel Etim-Effiong Say Him Journey to Marriage Start with Heartbreak Nollywood actor Daniel Etim-Effiong don open up say the road to forever with him wife Toyosi actually start from heartbreak and rejection and na from another woman entirely. For one recent interview with Chude Jideonwo, Etim-Effiong yarn say that time, him mind don ready for […]

Burna Boy Vex for People Wey No Want Am Perform for Burkina Faso Burna Boy say e shock as some people dey drop negative talk after e talk say e wan do free show for Burkina Faso. Di Grammy award winner no hold back as e reply people wey dey yab am over him decision to […]

Falz Talk Say E Fit No Raise Him Pikin for Naija  Because of Wahala Popular rapper and activist wey him name na Folarin Falana but people sabi am as Falz don talk say e fit no raise him pikin for Naija. The This Is Nigeria guy yan say e dey get threat because of him […]

Lojay Say Headies Get Value for Naija Artistes Pass Grammy Singer Lojay don talk why e believe say The Headies award dey more important to Naija artistes pass Grammy and other big-big international awards. As e take yarn for recent interview, the Grammy-nominated artiste talk say make Naija artistes begin take local awards more serious, […]

Kizz Daniel Yarn Say ‘Lemon Chase’ Na From Heart, No Be Hype Naija singer Kizz Daniel don open up say im new EP wey im name ‘Lemon Chase’ no be the normal way wey people dey do music business. Im talk say this EP wey get seven tracks no be just small taste of the […]


Current track

Title

Artist